Music

Soft No Be Weakness

“Soft No Be Weakness” the first confession from Monílolá MNL. A statement of peace, restraint, and power.

Gentle no cheap no test my mind……… This is the first page.

Lyrics for Soft no be weakness.

Heh… soft no mean easy, abeg.
Sometimes peace get price.

I dey cool, I dey smile, but no mean say I blind.
Night come, dem test my quiet, thunder wey I swallow inside.
Kept my hands inside my pocket, but the rage still dey bite.
Paid with scars wey no dey show; but my soul still dey fight.

I no go tell the scene make the mystery stay alive.
Silence get receipt; and I carry ham to survive.
Peace no be cheap; I pay the toll with my pride.
Soft still dey wait, when you press am hin e go rise.

Soft no be weakness I pay am.
Soft no be weakness I keep am.
Gentle no cheap no test my mind.
I hold my line tight hold am tight.

People laugh say I too gentle but dem no know the cost.
Dem think calm mean you empty till the night wey dem lost.
I no raise my voice; I just draw my boundary line.
If you push, you go know say the softness still get spine.

Some peace dey cost the nights we cry alone.
Some scars dey hide where light no shone.
I no regret the quiet path I choose.
Soft get teeth and e bite when you push.

Soft no be weakness I pay am.
Soft no be weakness I keep am.
Gentle no cheap no test my mind.
I hold my line tight hold am tight.

I choose peace… but peace dey cost.
No test my mind. Soft get teeth.

Credits

  • Written by: Monílolá MNL
  • Produced by: Yingisa
  • Mixed by: Boljbeatz
  • Mastered by: Boljbeatz
  • Artwork: Mgk_Graphix